Sunday, 13 October 2013

GOAT WAY!

This one wen FG no gree make we go school now, your boy just  dey they observe things oo.

As i enter canteen wan chop now, people  wey plenty just make me go si down dey wait till i fit join line, na im one small goat just run inside join line.





My people, line wen no gree move since begin move sharp-sharp ooo because of the commotion wey de goat cause, i just follow the goat reach front buy my own food ooo. I wish say this kind goat fit follow these lecturers reach OGA JONA side oo!

no just read comot, like the post or make you drop your own yarns join sef make we dey jolly go!

No comments:

Post a Comment